Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 17:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 So David enter Tabanako, sidan kon sey, “My Oga God! Na who bi mi and my family wey Yu dey do all dis tins for?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 17:16
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.


Den David enter Tabanako sidan kon bigin pray sey, “My Oga God! Mi and my family nor rish who Yu go do all dis good tins for.


Hezekaya take di leta from di messenja kon read am, den e go God Temple kon spread am on-top di altar.


So Profet Natan go tell David evritin wey God tell am.


Yu even do di ones wey big pass dis ones! Even my grand-grand shidren wey dem neva born, Yu don promise dem many tins! My Oga God! Why Yu dey trit mi like one big man?


“But who mi and my pipol bi? Wi nor really fit give Yu anytin, bikos na Yu get evritin and wi dey give Yu wetin Yu first give us.


Solomon ansa, “My God! Yu show sey Yu dey loyal to my papa David and Yu make mi king afta am.


My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so?


But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,


E save us from deat and E go diliver us. Wi don put awa hope for en hand sey E go diliver us again.


Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.


Gideon ansa, “My Oga! Na how I go take save Israel pipol? Na my family weak pass for Manasseh tribe and na mi small pass for di family!”


Samuel put one stone between Mizpa and Shen. E koll di place Ebeneza, bikos e sey, “Na God help us rish here.”


Saul ansa, “Na Benjamin tribe wey small pass for Israel, I from kom and na my family small pass for Benjamin tribe, wetin kon make yu dey tok to mi like dis?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ