Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 17:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Na-im go build temple for mi and I go make sure sey en kingdom dey forever.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 17:12
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God promise David my papa, ‘Yor pikin wey I go make king afta yu, go build temple for mi.’ And I don choose to build di temple where dem go for woship di Oga wey bi my God.


but yu nor go ever build am. Na yor own pikin go build my temple.’


Wen time don rish for yu to die, I go make one among yor pikin, king kon make en kingdom strong.


I go bi en papa and e go bi my pikin. I go always support am and I nor go leave am as I leave Saul wey yu take-ova from.


But dem ansa, Wi bi God for heaven and eart savants and wi dey ribuild di temple wey one pawaful king for Israel build before.


Make di king rule forever; make en kingdom kontinue as long as di sun dey shine. Make blessing dey all di nashons bikos of am, so dat dem go praiz am.


I go gi-am one son wey go take-ova from am and just as di days for heaven nor dey end, na so too en kingdom nor go ever end.


‘I go make en shidren-shidren king forever; dem go sidan for di throne from naw go rish wen di world go end.’ ”


So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


Christ go rule until e don put all en enemies under en pawa


Bikos na Christ dey show us evritin about God.


Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ