King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.
Dis na di family leaders for Levi tribe: Hashabaya, Sherebaya, Jeshua, Binnui, Kadmiel and di oda men wey dey stand face dem wen dem dey do di praiz and tanksgivin service and just as David wey dey serve God kommand dem, one group dey praiz with di oda group.