I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”
For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.
Wen King David don dey stay en palis, e kon tell Profet Natan, “I dey stay for palis wey dem build with cedar wood, but God Kovenant Box dey for tent!”
If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”