Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 16:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 Make una tank God, bikos E dey good, en love go dey forever.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 16:34
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den make all di trees for bush shaut with joy for God, bikos E dey kom judge di world.


Odas wey join dem na: Heman, Jedutun and di odas wey dem choose to dey praiz God, “Bikos en love dey forever.”


Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”


Doz wey dey blow trumpet and doz wey dey sing kon dey sing togeda dey praiz and give God all di glory. With di trumpet, cymbals and oda instruments, evribody kon dey shaut praiz God dey sey: “God dey good! En love and goodness, na forever and ever!” At wons, one kind tick kloud kon kover God Temple.


Wen evribody for Israel si sey fire kom down and God present full di temple, dem knee down kon face groun. Dem kon dey woship and tank God dey sey, “True-true, God dey good; en love wey nor dey fail, go dey forever!”


Dem sing praiz God sey: God dey good and en love for Israel nor dey end. Evribody kon bigin shaut praiz God with all dia pawa, bikos dem don start work for di temple.


Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda.


Make wi tank Oga God! Make wi koll en name kon tell di whole world about di tins wey E don do.


Make wi praiz God! Make wi tank am, bikos E dey good! E love wey nor dey fail, dey forever.


Make wi tank God, bikos E dey good! En love wey nor dey fail, dey forever.


Make wi tank God, bikos E dey good and en love dey-dey forever.


Una go hear am kon shaut with happiness, with joy and belle go sweet una wen una dey do marriage. Una go hear pipol dey sing as dem dey kom tank mi with dia ofrin. Dem go sey, ‘Make wi tank God wey dey mighty, bikos E good well-well and en love dey forever.’ I go make dis land prosper as e bi before. Mi, wey bi God, don tok.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ