Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 16:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Make di heavens and eart dey happy! Make una tell di whole world sey, na God bi king.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 16:31
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make evritin wey dey dis world fear God! God don make di world stand and nor-tin go fit move or break am.


I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.


Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.


Na God dey rule all di nashons, even as E sidan for en holy throne.


So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good.


Make una tell di nashons sey, “Na God dey reign!” Di world stand gidigba and dem nor go fit shake am. God go judge evribody akordin to wetin dem do.


God na king! Make di eart happy! Make river and sea happy too.


So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy!


Na God bi king! Make di nashons shake with fear! E sidan for en throne where di angels wey get feadas dey and make di eart shake.


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.


So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.


Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’


I tell una true word, na so God angels dey happy, wen one sina turn from sin kom meet God.”


Di angel tell dem, “Make una nor fear! Make una listin well, bikos I kom tell una news wey go make pipol happy.


Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ