God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.
God tell en pipol sey, “Wen di time don rish to save una, I go favor and ansa una wen una kry for help. I go guide and protet una kon make kovenant with evribody thru una. Una land wey skata and wey dirty bin full, I go klean am kon make una stay der again.
Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”