Naw, make yu give di woman back to en husband, bikos true-true Abraham na profet and e go pray for yu and yu nor go die. But if yu nor gri give di woman back to en husband, make yu know sey yu must die with evritin wey yu get, even all yor pipol.”
Make yu still anoint Jehu wey bi Nimshi pikin, as Israel king. Den yu go anoint Elisha wey Shafat born, wey kom from Abel-Meholah, bikos na en go bi profet afta yu.
As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.