20 Dem dey waka from kountry to kountry and from town to town.
But honga kon dey di land, so Abram go Egypt go stay der small, bikos di honga strong well-well.
Abraham travel from der go Negev aria kon stay between Kadesh and Shur. As Abraham bi strenja for Gerar,
God sey, “Na mi bi God, di God wey yor papa serve. Make yu nor fear to go Egypt, bikos na der I go for make yu bi one strong nashon.
Jakob and all en shidren karry dia animals and propaty wey dem get for Kanaan kon go Egypt.
Dat time, God pipol nor many and dem bi strenjas for di land.
God nor let anybody opress dem; instead, E ponish kings bikos of dem kon sey: