Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham.
Den God tell am, “Na mi bi di God wey get pawa. Yu go dey fruitful and yor propaty go plenty! One nashon; even many nashon go kom from yu and kings go dey join yor shidren-shidren!
David hear sey God don bless Obed-Edom family and evritin wey e get, so e kon karry di Kovenant Box komot from Obed-Edom house go Jerusalem as dem dey celebrate.
Na bikos Yu si as e dey faithful rish, naim make Yu make kovenant with am. Yu promise to gi-am Kanaan, Hit, Amor, Periz, Jebus and Girgash pipol land. Di land wey en shidren-shidren go stay and Yu keep yor promise, bikos Yu dey faithful.
God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.
All of una get share for inside di promise wey God make with una grand-grand papa dem thru di profets. Na so E tell Abraham sey, ‘Na thru di pikin wey yu go born, naim I go take bless all di family wey dey di world.’
But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt.