13 bikos na una bi Israel shidren-shidren; God savant; pipol wey kom from Jakob wey God don choose as en own!
“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.
Make una remember all di mirakles wey E do, en wonderful works and di way E take dey judge,
Na-im bi di Oga awa God! Na-im dey judge di whole eart.
us wey bi en savants, Abraham shidren and wi wey bi Jakob wey E choose, shidren-shidren.
True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.
“But Israel na my savant! Di pipol wey I choose, wey bi my friend Abraham shidren-shidren;
Israel and Judah pipol wey God take komot from Egypt, make una listin to wetin E tok against una.
Yet God show en love to una grand-grand papa dem. And E choose una wey bi dia grand-shidren above evry oda pipol, as all of us dey si am today.
Bikos una dey holy and na di Oga una God bi una papa. From all di pipol wey dey di eart, di Oga una God don choose una to bi en own special pipol.
But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.