Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 15:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 So King David, Israel leaders and all di sojas oga, go Obed-Edom house go karry di Kovenant Box kom Jerusalem and dem kon dey sing and dance.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 15:25
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Solomon koll all di leaders for Israel tribe and villages kon tell dem, “Make una karry God Kovenant Box go di temple for Zion wey bi David Town.”


(For dis time, David don take di Kovenant Box from Kiriat-Jearim go di place wey e prepare for am for Jerusalem.


Den Solomon sey make all di eldas for Israel, plus all di leaders for di tribes and family for Israel, kom meet am for Jerusalem, so dat dem go dey der wen dem dey karry di Kovenant Box kom from David Town (wey bi Zion).


Den Israel pipol, di priests, Levi pipol and all di oda pipol wey kom back from Babilon kon dedikate di temple with joy.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


Moses vex with di ofisas and di leaders wen dem kom back from di war.


“So I take di men wey una selet by unasef kon make dem judge and ofisas ova una. Some dey lead 1,000 pipol, some hundred, some fifty, while some na only ten pipol.


Una must chop dis tins for di Oga una God present and e go bi for di place wey E choose. Make una chop for der with una shidren and Levi wey dey stay with una and for evritin wey una dey do, make una dey celebrate for di Oga una God present.


For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.


Dis na time to celebrate before di Oga una God for di place wey dem for dey woship am; di place wey E choose sey make dem honor en name. Make una celebrate with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die wey dey stay with una.


Una must celebrate dis feast for seven days to honor di Oga una God for di place wey E choose, bikos na en bless una well-well kon make all una work, prosper. Dis feast go bi time for evribody to happy.


Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.


Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!


But today, una don rijet di God wey save una from all una trobols and wahala. Una don sey, “No! Choose king wey go rule us.” Naw make una stand for God present akordin to una tribe and family.’ ”


Saul tell dem, “All of una wey kom from Benjamin tribe! Make una listin! Jesse pikin don give field and vineyard to any of una before? Or e don make any of una kommander and offisa?


“Na only en go choose leaders wey go dey look ova tazon and doz wey go dey look ova fifty, plus doz wey go dey klear en field kon harvest wetin e plant and dem go dey make en war materials for am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ