22 Bikos Kenanaya sabi play music well-well, dem kon make am dia leader.
David still kommand Levi leaders sey, “Make Levi pipol use harp and cymbals take play music.”
Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya, Obed-Edom, Jeiel and Azazaya dey play di lyres.
Dem choose Berakaya and Elkanah make dem dey guide di Kovenant Box.
Doz wey dey play music, with Shenanaya wey bi dia leader and Levi pipol wey karry di box, wear one robe wey dem make with fine linen. David too dress like priest and e wear robe too.