Di pipol wey dem choose to assist dem na: Zekaraya, Jaaziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Benaya Maaseaya, Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya and Obed-Edom and Jeiel wey dey guide di gate.
Dem sey make Asaf lead dem, while Zekaraya go dey help am. Den make Jeiel, Shemiramot, Jehiel, Mattitaya, Eliab, Benaya, Obed-Edom and Jeiel play harp, while Asaf go dey play di cymbal.
“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.