David hear sey God don bless Obed-Edom family and evritin wey e get, so e kon karry di Kovenant Box komot from Obed-Edom house go Jerusalem as dem dey celebrate.
Na only di pesin wey sidan for di Most Holy Place front, fit si di pole end and nobody fit si dem from any oda place. Di poles still dey der till today.
Di poles long well-well sotey dem dey si dia end from di temple main room and di Most Holy Place, but nor bi from outside. Dem still dey der till today.
Wen Aaron and en sons don kover di Holy Place and en tools finish; wen time don rish for di pipol to travel, Kohat pipol go karry doz tins; but dem nor go tosh anytin wey dey holy, bikos if dem tosh am, dem go die. Dis na Kohat pipol work for di tent.
For dat time, God separate Levi tribe sey make dem karry God Kovenant Box kon stand for God present to serve am and na dem go dey bless pipol with en name and na so e bi till today.