E tell dem, “Na una bi leaders for Levi tribe. Make una klean all Levi pipol and unasef, so dat una go fit bring di Oga wey bi Israel God, Kovenant Box kom di place wey I make for am.
But dem nor get enough priest to kill all di animals. So, Levi pipol wey bi dia brodas kon help dem till di work finish and di priest santify demsef. Levi pipol even santify demsef pass di priest.
Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.