But di king give orda sey make Absalom nor stay for di palis. Di king sey, “I nor won si am.” So Absalom go stay for en own house and e nor kom where di king dey.
Afta dem don kapture der, David stay der kon koll am, “David Town.” E build house round am and e start from di dry land go rish di east side for di hill.
David hear sey God don bless Obed-Edom family and evritin wey e get, so e kon karry di Kovenant Box komot from Obed-Edom house go Jerusalem as dem dey celebrate.
E tell dem, “Na una bi leaders for Levi tribe. Make una klean all Levi pipol and unasef, so dat una go fit bring di Oga wey bi Israel God, Kovenant Box kom di place wey I make for am.
Den Solomon sey make all di eldas for Israel, plus all di leaders for di tribes and family for Israel, kom meet am for Jerusalem, so dat dem go dey der wen dem dey karry di Kovenant Box kom from David Town (wey bi Zion).