Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kronikles 14:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 David know sey na God make am king for Israel and E dey prosper en kingdom and pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kronikles 14:2
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

En house and kingdom go dey before mi forever; en family go rule forever.’ ”


So make yu tell David wey bi my savant sey, di Oga God sey, ‘I take yu komot from where yu dey kare for animal kon make yu rule Israel wey bi my pipol.


Make wi praiz di Oga wey bi yor God! E don show how E dey happy with yu, bikos E make yu king for Israel and di love wey E get for Israel pipol, go last forever. E don make yu dia king, so dat yu go fit keep di law and dey judge well.”


King Hiram for Tyre kon send message go give David sey make dem do business togeda. E still send cedar wood, stones and karpenters make dem take build one palis for David.


David marry plenty wifes for Jerusalem and e born many shidren.


Yu even do di ones wey big pass dis ones! Even my grand-grand shidren wey dem neva born, Yu don promise dem many tins! My Oga God! Why Yu dey trit mi like one big man?


Si, yor savants wey go kut di wood, I go pay dem with 20,000 bag of wheat, 20,000 bag of barley, 120,000 gallon of wine and 120,000 gallon of olive oil.”


King Hiram for Tyre kon send dis leta go give Solomon: “Bikos God love en pipol, E kon make yu king.”


If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”


Naw, God tell mi dis dream nor bi bikos na mi wise pass, but na to make yu my king, undastand wetin yu dey tink for yor mind.


Dem go get enough rain and dia shidren-shidren go plenty like river; dia kings go get pawa pass Agag and pipol go praiz dia kingdom.


If una really obey God kon keep en kommand wey I dey give una today, di Oga una God go make una high pass all di pipol for di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ