bikos God don make Siria sojas hear nois like sey many sojas with dia shariot dey kom fight dem. So Siria sojas tell demsef, “Si, Israel king don go hire Hit and Egypt kings with dia sojas, so dat dem go kom attack us.”
Di mountin dey make nois like wen many sojas dey mash! Strong wahala dey among di kingdoms and nashons dey gada togeda! Oga God wey dey lead heaven sojas, dey gada dem togeda to go fight.
“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.
Deborah tell Barak, “Make yu ready, bikos God dey lead yu and today E go give yu viktory ova Sisera.” So Barak kom down from Mount Tabor with en 10,000 men.
Wen Gideon hear di dream and wetin e mean, e knee down kon woship God. Den e go back to en kamp kon sey, “Make una get up! Bikos God don give us viktory ova Midian sojas.”