14 Den David ask God again and E sey, “Nor attack dem from dis side, but go pass thru where di Balsam trees dey.
David ask God again and E ansa, “Nor attack dem from here, but go round make yu ready to attack dem from di oda side near where Balsam trees dey.
So David ask God, “Make I go attack Filistia pipol? Yu go dey with mi?” God ansa, “Yes! Go attack dem, bikos I go dey with yu!”
E nor too tey before Filistia pipol go skata di valley again.
And wen yu hear pipol dey mash on-top di trees, make yu attack dem bikos, I go mash go yor front go distroy Filistia sojas.”
Na only one tin I ask from God and dat na wetin I wont! Na make I stay for God house forever, so dat I go dey si en mighty works kon always dey happy for inside en temple.