11 David vex well-well, bikos God kill Uzza, so e koll di place Perez Uzza and na-im dem dey koll am till today.
Dat na why till today, Israel pipol nor dey chop di meat wey dey lap, bikos di man tosh Jakob lap.
At wons, God vex well-well for Uzza kon kill-am, bikos e nor respet God and Uzza die near di box.
Den, David fear God well-well kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box follow body naw?”
At wons, God vex kon kill Uzza, bikos e tosh di box.
Den David kon dey fear God dat day so e kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box naw?”
God ponish us, bikos una nor dey der to karry am for di first time and wi nor woship am as wi suppose to.”
Even di priests wey dey near mi, make yu tell dem make dem wosh demsef well-well, if not I go distroy dem too.”
Den Oga God kon ansa Jonah, “Na wish rite yu get to dey vex?”
But God tell am, “Wish rite yu get to dey vex bikos of di small plant?” Jonah ansa, “I get evry rite to vex till I die!”
God beri am for Moab land near Bet-Peor, but kon rish today, nobody fit sey, “Na here or na der God beri Moses put.”
For di river centre where di priests wey karry di Kovenant Box stand put, Joshua kon put twelf stones for der. Di stones still dey der still today.