Some strong sojas for Gad wey dem don train for war kon go join David too. Dem dey karry shield and spear. Dem bi like wiked lion and dem dey run fast like deer wey dey di hill.
Mered still marry one woman wey kom from Judah tribe and dem born three sons: Jared wey build Gedor town: Heba wey build Soko town and Jekutiel wey build Zanoah town.