33 From Zebulun: na 50,000 sojas wey karry difren weapon and dem dey ready for war.
From Naftali: na 1,000 ofisas with 37,000 sojas with dia shield and spear.
From Asher: na 40,000 sojas and dem dey ready for war.
All dis men na sojas wey dey ready to fight. Dem kom Hebron kon make David king ova Israel pipol. In-short, evribody for Israel gri sey make David bi dia king.
So di king kon ask di wise men wey know about matter wey koncern dia law and rule, bikos e dey always ask dem for advise.
Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.
Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”