30 From Efraim: na 20,800 popula men for dia village.
Before-before and even leta, Nefilim pipol (giant pipol) dey for di eart and na God sons born dem wen dem dey sleep with ordinary wimen. Na dem bi di wariors wey pipol bin know for evriwhere.
Abner wey bi Ner pikin and Saul soja oga, run with Saul pikin wey dem dey koll Ish-Boshet cross Jordan River go Mahanaim.
Na for der Abner for make Ish-Boshet king for Gilead, Asher, Jezrel, Efraim, Benjamin and all Israel aria.
Abner still tok to Benjamin tribe kon go Hebron go tell David wetin Benjamin and Israel pipol agri to do.
From Benjamin wey bi Saul tribe: na 3,000 men wey dey loyal to Saul before.
From half of Manasseh tribe: na 18,000 sojas wey dem sey make dem kon make David king.