For di first mont for di year, wen Jordan River dey flow enter land, dem kon cross go skata di pipol wey dey stay di valley, for di east and west side for di river.
David go meet dem kon sey, “If una kom like friends kon help mi, den I go make agriment with una! But if una kom sell mi give my enemies wen I nor tosh or wound una, make awa grand-grand papa God si evritin kon judge una.”
Some strong sojas for Gad wey dem don train for war kon go join David too. Dem dey karry shield and spear. Dem bi like wiked lion and dem dey run fast like deer wey dey di hill.
Saul tell dem, “All of una wey kom from Benjamin tribe! Make una listin! Jesse pikin don give field and vineyard to any of una before? Or e don make any of una kommander and offisa?