7 David go stay for where dia betta propaty dey and na dis make dem dey koll am, David Town.
But David win Zion take and dem kon dey koll am, “David Town.”
Jebus pipol kon tell David sey e nor go fit enter di town, but David seize where God propaty dey for Zion, so dem kon dey koll di place, “David Town.”
David sey, “Di first man wey go attack Jebus pipol, na-im go bi di sojas oga!” So Joab wey en mama na Zeruaya, first attack and kill dem, so e kon bi di sojas oga.
David build di town again. E start from where big land dey for di east for di hill and Joab kon build di remainin side.
“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”