1 Kronikles 11:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
20 Na Joab broda, Abishai dey lead di three strong sojas. E use en spear take fight three hundred men kon kill all of dem, den e kon dey popula with di three strong sojas.
E divide dem into three groups kon send dem out. Na Joab, Abishai wey bi Joab broda and Ittai wey kom from Gat, dey kommand each group. Di king tell en men, “I go follow una go.”
So di king tell Abishai, “Sheba go give us wahala pass Absalom. So make yu take my men go fine am or e go enter some town wey dem dey guide well-well kon run from us.”
But Abishai, Zeruaya son, run kom help David attack di giant kon kill-am. Den David men kon sey make David promise dem sey e nor go follow dem go fight war again. Dem sey, “Na yu bi di hope wey Israel get and wi nor won luz yu.”
kon sey, “I nor fit drink dis wota, bikos e go bi like sey I dey drink dis men wey risk dia life, blood!” So e nor drink am. So dis na wetin di three strong sojas do.
David tell Ahimelek wey kom from Hit and Abishai; Joab broda wey kom from Zeruaya sey, “Who go follow mi go meet Saul for en kamp?” Abishai kon ansa, “I go follow yu go.”