1 Kronikles 11:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
18 Di three strong sojas kon force diasef pass Filistia pipol kamp, draw wota from di well kon give David. But e nor gri drink am, instead, e pour am for groun as ofrin to God
Di three sojas wey get pawa well-well kon force demsef pass Filistia pipol kamp and dem draw wota from di well kon go give David. But e nor gri drink am; instead, e pour am as ofrin for God
kon sey, “I nor fit drink dis wota, bikos e go bi like sey I dey drink dis men wey risk dia life, blood!” So e nor drink am. So dis na wetin di three strong sojas do.
Make only mi dey yor heart and make I bi like betta ring for yor hand, bikos love strong like deat and feelins for pesin, bi like grave wey nor dey full. E bi like heavy fire and e dey katch well-well.
But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.
But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”
E risk en life wen e fight and kill Filistia pipol. God win big viktory for Israel pipol. Wen yu si and hear am, yu yorsef kon dey happy. So wetin go make yu won sin against pesin wey nor do any bad tin? Wetin go make yu won kill David yor savant for no rizin?”
Afta dem don gada for Mizpa, dem kon draw wota pour put for God front. Dem nor chop for dat day and dem kon konfess all dia sins for der dey sey, “Wi know sey wi don sin against God.” So Samuel pray for Israel pipol for Mizpa.