Den Saul tell di boy wey karry en swod sey, “Make yu kill mi with yor swod, so dat all dis Filistia pipol wey nor know God nor go kom sofa mi.” But fear nor let di boy do am. So Saul take en own swod take kill ensef.
E kwik-kwik koll di pesin wey karry en weapon kon tell am, “Make yu kill mi with yor swod, so dat dem nor go sey, ‘Na woman kill mi.’ ” So di pesin use en swod take shuk am and e kon die.