3 Di fight strong well-well for where Saul dey, so di enemies spear kon tosh and wound King Saul.
But Filistia pipol porshu dem katch kon kill Saul three shidren: Jonatan, Abinadab and Malki-Shua.
Den Saul tell di boy wey karry en swod sey, “Make yu kill mi with yor swod, so dat all dis Filistia pipol wey nor know God nor go kom sofa mi.” But fear nor let di boy do am. So Saul take en own swod take kill ensef.
Even doz wey dey run fast nor go fit eskape; strong men nor go get pawa again and sojas nor go fit save dia own life.