Make rain or dew nor fall for Mount Gilboa, make di fields nor produce fruit at-all! Bikos na for der dem for disgrace strong sojas with all di pawa wey dem get. Dem abandon Saul shield wey e take dey protet ensef and dem nor rub oil put.
E ansa, “Na from Mount Gilboa I from si Saul as e knee down with en spear and I si sey di enemy shariot and doz wey dey ride dem don dey near am well-well.
e kon go kollect Saul and Jonatan en pikin bones from Jabesh pipol for Gilead. (Dem bin karry dem form Bet-Shan for where dem hang dem put afta Filistia pipol kill Saul for Mount Gilboa.)
Afta some time, Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. So Akish kon tell David, “Hope yu know sey yu and yor men go follow mi go fight.”