34 Na Abraham bi Isaak papa. Isaak shidren na: Esau and Jakob (wey God shange en name to Israel).
Dis na di story about Abraham pikin Isaak. Abraham na Isaak papa.
Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
Den Jakob ask am, “Abeg make yu tell mi yor name.” But di man sey, “Why yu dey ask for my name?” So e kon bless am.
Abraham born two sons: Isaak and Ishmael.
Midian shidren na Efah, Efer, Hanok, Abidan and Eldaah. All dis pipol na Keturah sons.
Abraham born Isaak, Isaak kon born Jakob. Na Jakob born Judah and en brodas,
Jakob wey Isaak born, naim bi Judah papa. Abraham born Isaak and na Terah wey Nahor born, bi Abraham papa.
So God make kovenant with Abraham thru sekonsishon. Abraham kon born Isaak and sekonsaiz am afta eight days. Isaak born Jakob and Jakob born di twelf brodas, wey bi awa grand-grand papa dem.