Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 9:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 E get any soja wey dey pay ensef salari? Abi who plant vegitabol, nor dey chop for inside? Or who dey keep sheep nor dey drink from dia milk?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 9:7
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu kare for yor fig tree and yu go get many fig fruit to chop and na like dis too, dem go honor savant wey dey kare for en masta.


and yu go get plenty goat milk to take feed yu, yor family and yor wimen savant.


But na only mi get my vineyard and Solomon nor nid to pay 1,000 silva koin. But I go give two hundred silva koin to di pipol wey dey kare for di vines.


dem go still produce enough milk for am. Yes! Di few pipol wey go survive go si plenty food chop.


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


Dem go give di same food like di oda priests and e fit keep anytin wey en family send kom gi-am.


E get anybody for here wey just plant vineyard and neva chop anytin from am? If na so, yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go chop di first fruit for yor harvest.


Timoti my pikin, na as dem tok for di words wey dem profesai about yu before, na-im make mi give yu dis kommand. So make dis words make yu strong as yu dey fight for Christ.


Make yu fight di fight wey dey make faith strong and whole di life wey nor dey end, wey go make pipol praiz God, bikos na dis make am koll yu.


I don fight di good fight for di faith wey I get; I don run di race finish; I don do wetin I promise sey I go do.


Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ