Nor bi di karpenter, wey Mary born bi dis? Nor bi en brodas bi James, Josef, Judas and Simon? Nor bi en sistas dey with us so?” So dem kon dey vex for am.
Andru kon bring Simon kom meet Jesus. Wen Jesus si am, e tell am, “Yu bi Simon, John pikin, na Cefas (wey mean Pita) pipol go dey koll yu from today go.”
Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”
But if di one wey nor bilive komot from di marriage, make e bi like dat. For dis kind kase, di broda or sista wey bilive, don dey free; bikos God wont make wi enjoy peace.
Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha.
Dem dey tish sey, e nor good to marry or chop some kind food. But na God kreate dis food and E sey pipol wey bilive di trut fit chop am afta dem don tank am.
Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.