Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 9:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 So I nor dey run for nor-tin and I nor dey follow breeze fight.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 9:26
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

From John di Baptist time kon rish naw, pipol dey struggol to enter God Kingdom, but na only doz wey dey struggol well-well, dey fit enter.


“Make una struggol well-well so dat una go fit pass di small door, bikos many pipol go try to enter God Kingdom, but dem nor go fit.


Na so e bi wen una dey tok with difren-difren language wey pipol nor undastand. If nobody fit undastand wetin una dey tok about, dat mean sey na breeze una dey follow tok.


Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.


So wi dey always get di mind sey wi go die komot from dis world, so dat wi go-go stay with Jesus Christ for where e dey.


I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.


Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.


Bikos to mi, to dey dis life, na to live for Christ and to die inside Christ, na dat one betta pass.


So na dis tins I dey struggol and work for akordin to en pawa wey dey work inside mi.


And naim make mi dey sofa wetin I dey sofa so. But I nor dey shame, bikos I know di Pesin wey I dey serve and I dey sure sey, E go guide di tin wey I gi-am whole, until di day wey Christ go kom.


Bikos anybody wey dey run race, nor go fit win unless e follow di rule wey dey di game.


I don fight di good fight for di faith wey I get; I don run di race finish; I don do wetin I promise sey I go do.


Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.


Even doh God promise us rest, e good make wi dey kareful, so dat some among us nor go miss di promise.


Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey:


So my brodas and sistas, make una do evritin to show sey, God koll and choose una. As una dey do so, una nor go ever fall inside sin.


E leave doz nashon for der, bikos E won use dem take tish di yong pipol for Israel wey neva fight war before.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ