Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 9:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 9:24
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and e dey shine kom out like man wey just marry. E dey happy like pesin wey dey ready to run race.


I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.


Den God ansa, “Jeremaya, if yu don taya to follow dis pipol run, how yu won take follow horse run? If yu nor fit stand for open land, how yu won take stay for forest near Jordan?


I send my profets kon warn una with many vishon and parabol.


Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.


Una nor know sey doz wey dey work for di temple dey chop food wey pipol bring kon give God for der? Abi una nor know sey pesin wey dey serve for altar na from der e for dey chop?


Na di gospel make mi dey do all dis tins, so dat I go fit share for di blessings.


So I nor dey run for nor-tin and I nor dey follow breeze fight.


I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.


Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut?


bikos una get God message wey dey give life. So, di day wen Christ go kom, I go get rizin to boast sey I nor run dis race or work for nor-tin.


Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.


and as I put my mind for dis tins, I dey try to get di prize wey bi life for heaven; prize wey make God koll us thru en pikin, Jesus Christ.


Make una nor let doz wey dey pritend and woship angels judge una. Dat kind pesin dey tok anyhow about vishon wey e sey e si, but na yeye tins and sin full en mind.


Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.


Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.


I go soon kom. Make yu whole wetin yu get well-well, so dat nobody go take yor crown from yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ