1 Korintians 9:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
12 If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message.
“Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una don seize di key wey dey make pipol know di trut! Since una nor gri enter, una nor wont make oda pipol enter too.”
But I nor dey use all dis rite and I nor dey rite dis tins so dat pesin go give mi sometin. E betta make I die, dan make anybody kon make mi stop to dey tok like dis.
Bikos if I dey prish di gospel, I nor get any rizin to boast, bikos I nor fit do any oda tin dan to dey prish di gospel! Na wahala for mi, if I nor prish di gospel!