10 No! Na wi God dey tok about. Dem rite all dis tins for di law, so dat evribody wey work, go fit chop for harvest time.
Una fit chop am for anywhere; both una and una family, bikos na una salari for una work for di tent where dem for dey do meetin, bi dat.
And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.
Bikos evritin wey dem rite from biginnin, na to tish, enkourage and give us hope.
All of us na ko-workers for God and na una bi God farm and en buildings.
All dis tins na for una good, so dat God grace wey dey rish many pipol evriday, go make pipol dey tank God more-more and all di glory go bi en own.
Farmer wey work well-well, naim suppose get di first share for di harvest.