For nite for di next day, Jesus kon stand near Paul tell am for vishon, “Make yu nor fear, bikos as yu don testify about mi for Jerusalem, na so yu go still do for Rome.”
So Ananias go di house and wen e enter, e put en hand for Saul head kon sey, “Broda Saul, di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom meet yu, so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.”
Na only tins wey eye fit si, naim una know. If anybody dey sure sey e bilong to Christ, make e tink about am again: If e bilong to Christ, den wi na Christ own too.
Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie).