Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 8:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Nor bi evribody know dis tins. Some pipol don grow with di bilive sey juju dey alive. So wen dem dey chop meat wey dem give juju, dem go dey fear.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 8:7
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.


As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin.


My friends, I dey sure sey una dey good; know God well-well and fit tish one anoda.


Make una mind dey okay as una dey chop any meat wey dem dey sell for market.


For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda.


So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.


Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ