“Israel God wey get pawa; di Pesin wey sidan for where high pass di creatures wey get feadas. Na only Yu bi God wey dey rule all di kingdoms for dis world. Na Yu kreate di eart and di sky.
Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.
God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.
God tell Israel pipol sey, “Egypt, Sudan and doz tall pipol for Seba with evritin wey dem get, go bi una own. Dem go waka follow una with shains for dia leg; bow for una kon beg dey sey, ‘True-true, God dey with una and e nor get anybody wey bi like am. Yes! E nor get any oda god.’ ”
But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.
All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
“Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem.
but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.
And una don si and hear sey dis Paul don take many pipol komot from awa hand. Nor bi only for dis Efesus, but for di whole Asia, bikos e dey tell dem sey di gods wey dem mold, nor bi god at-all.
For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda.
God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.