For where dem for dey woship, dem dey kover diasef with klot wey dem kollect from poor pipol as payment for debts. For inside God temple, dem dey drink wine wey dem kollect from doz wey dey whole dem money.
but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.
As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin.