4 Nor bi di wife get en own body, but na di husband get am and na so too di wife get en husband body.
Den I tell am, “Yu must always dey with mi and nor do ashawo or go sleep with anoda man again and mi mysef go dey with yu.”
Naw I tell una, anybody wey drive en wife, wey nor bi sey e sleep with anoda man, but kon marry anoda woman, don kommit adultery.”
Make husband and wife do di rite tin wey dem suppose do for one anoda.
Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.