Many men nor fit sleep with woman, bikos na so dem born dem, some na human being do dem like dat, but odas na bikos of God Kingdom. Anybody wey fit asept wetin I tok, make e take am like dat.”
Di seeds wey fall for shuku-shuku, na di pipol wey hear God word, but wahala, plenty propaty and jolly-jolly for dis world kon shuk dem, so di fruit nor even ripe.
If pesin wey neva marry before kon marry, e nor sin. But, pipol wey don marry go face plenty wahala and I dey try to help una, so dat una nor go face dat kind wahala.
To dey sleep with pesin wey yu nor marry; dey do tins wey nor dey pure and get long-trot, make una nor allow dis tins dey among una, bikos dem nor good for God pipol.
Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.
Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings
Make yu tish old wimen sey, make dem live life wey go make God happy. Make dem nor tok bad about pipol; nor dey drink anyhow, instead make dem tish oda wimen wetin dey good.