1 Korintians 7:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
25 Koncerning pipol wey neva marry before, I nor get any kommand from Christ to give una, but I go advise una as pesin wey una fit trust, bikos God dey show mi mesi.
Even doh I dey tok on my own, I nor tink sey God go tok anytin difren from wetin I dey tell una about marriage. Di only tin wey I fit do na to give una my advise. If yor wife nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor drive am.
If pesin wey neva marry before kon marry, e nor sin. But, pipol wey don marry go face plenty wahala and I dey try to help una, so dat una nor go face dat kind wahala.
so e go dey tink about difren tins. Woman wey neva marry dey only tink of how to make belle sweet Christ. Dat time, dia body and mind dey pure. But woman wey don marry dey worry about dis world tins, bikos e wont make belle sweet en husband.
Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.