Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 7:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 but if e leave am, make e nor marry again or make e go back go setol with di man. And make husband nor leave en wife too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 7:11
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


God sey, “If man drive en wife and di woman go marry anoda man, di man go fit go marry di woman again? Dat kind tin go make di land dirty. But Israel pipol, una bi ashawo wey get many husband and naw, una won turn back kom meet mi.


But I dey tell una naw sey, anybody wey drive en wife komot from marriage, wey nor bi sey di woman sleep with anoda man, don make di woman kommit adultery and any man wey marry di woman, don kommit adultery too.”


And any woman wey leave en husband, den e go marry anoda man, don kommit adultery too.”


Den, some Farisee pipol wey won test am kon ask am, “E bad make man drive en wife at-all?”


“Any man wey drive en wife, den marry anoda woman, don kommit adultery and di man wey marry woman wey leave en husband, don kommit adultery too.”


Na doz wey don marry I won give dis kommand to (Nor bi mi, but na God): Make wife nor leave en husband,


Even doh I dey tok on my own, I nor tink sey God go tok anytin difren from wetin I dey tell una about marriage. Di only tin wey I fit do na to give una my advise. If yor wife nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor drive am.


Dem go still tell am make e pay 100 silva to di woman papa, bikos na for publik e for curse di woman sey e nor bi virgin. Den di woman go still bi di man wife and e nor go fit sey make di woman pak komot from en house.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ