My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.
“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
Di seeds wey fall for shuku-shuku, na di pipol wey hear God word, but wahala, plenty propaty and jolly-jolly for dis world kon shuk dem, so di fruit nor even ripe.
And I still dey remind una about di angels wey nor stay for where God put dem, but kon komot for where dem suppose dey. God don shain dem tie for darkness until wen E go judge di world.