Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;
I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.
To dey sleep with pesin wey yu nor marry; dey do tins wey nor dey pure and get long-trot, make una nor allow dis tins dey among una, bikos dem nor good for God pipol.
So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.
Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart.
Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.