But Josef tell dem, “I nor go fit do dat tin! Di man wey dem for si di cup for en hand go bi my savant and di rest of una fit go meet una papa with peace.”
So dis mean sey na wetin good kill mi? No! But na sin pawa wey dey inside mi, na-im kill mi; bikos e use wetin good bring deat and naw, wi dey si how sin bad and wiked rish.
Dis mean sey di law nor good? No! But na di law make mi know wetin sin bi. If to sey di law nor sey, “Nor get long-trot for anoda man tin,” I nor for know sey I nor suppose to do dat kind tin.
Una still dey sey, “Food dey good for awa body and awa body nid food.” But I dey tell una, “God go distroy di two of dem.” So make wi nor use awa body take do yeye tins.
I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.