Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 6:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 6:10
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If yu enter en house, den deat dey hongry yu, bikos na short kut to deat bi dat.


Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.


God sey, Una tink sey my temple na where tif dey hide put? Make una know sey I don si wetin una dey do.


“Si, I dey klap my hand as una dey tif and kill.


Pipol wey dey rule bi like wolf wey tear animal into too. Dem dey kill pipol, so dat dem go get money.


Doz wey get money dey shit and tif from oda pipol. Dem dey ponish poor pipol and dey kollect strenjas propaty.


E si one fig tree for road kon waka go where e dey, but e nor si anytin plok, bikos na only leaf di tree get. So e kon tell di tree, “Yu nor go ever bear fruit again!” At wons, di fig tree kon bigin die.


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


“Una bi snake! Wiked snake shidren! How una go take eskape hell?


(Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)


Naw, I leave una for God hand, so make en word wey get grace, keep una. Dis word wey get grace fit make una grow and get share with all God pipol.


My friends, I wont make una know sey awa body wey get blood go rotin. Dat mean sey dis kind body, nor go fit enter God kingdom wey go dey forever.


But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin.


bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!


Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.


One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.


Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.


But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ